AKPORS JOKES



Akpos: Good day sir, I call to ask for d number wey people take dey call una for dis programme.


Radio Presenter: But you have called us already, why would you need number that people use to call us.


Akpors: Nop, I saw dis number already saved as Naija FM on my phone and as I dey listen to radio dis morning, na Naija FM I tune am to, dat is why I call so dat una go give me number to take call una.


Radio Presenter: Is that you Akpors?


Akpors: Yea, my name is Akpors, how do you know my name.


Radio Presenter: You no dey serious Akpors, u later wash those plate wey we take eat Eba yesternight?.


Akpors: Shey na Mukuro be that?
Radio Presenter: Yes
Akpors: So na Naija FM you dey work now, so na u save Naija FM for my phone, chai, I pity Naija FM manager for employing bad luck like you, shey you don forget say na d second week wey Dana Airline
employe you na him one of thier plane crash?, abi you wan tell me say u don forget say na when you buy Okada na him Governor Fashola ban Okada for Lagos State or do you mean to tell me say u don forget
say na when you go north go work na him Boko Haram start their operation, and since d beginning of dis month wey you don dey comot wey I no dey know where u dey go na him I don need to buy external Antenal
join my Radio before I go fit hear Naija FM, ever since then, I need to climb a tree before I go see service. now wey you come start work as presenter for Naija FM, I wonder wetin go happen to dem o.


¤¤Radio Presenter fainted¤¤




Comments

Popular posts from this blog

NIGERIA EBOLA DOCTOR CONTRACTED THE VIRUS; it is the second confirmed Nigeria case, health minister says.

WASTE DISLODGER